Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (2024)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, EPA

Kenya President William Ruto claim say 'criminals' don hijack di anti-tax protests wey dey happun now for im kontri.

Ruto tok say organised criminals don "enta and hijack," di anti-tax protest as im bin dey address di violent I-no-go-gree wey bin occur on Tuesday.

"E dey very painful for Kenya say dangerous pipo don hijack conversation wey important like dis," im kontinu.

"E no dey in order say criminals wey dey pretend to be peaceful protestors fit raise terror against di pipo - and expect to go scot free."

E say im goment don deploy all available resources to fight di pipo wey dey "undermine di security of di kontri".

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

  • Ghana actress Yvonne Nelson lead citizens to demand goment to fix power crisis for #DumsorMustStop protest

  • Nurses and midwives for Nigeria protest ova new regulations wey dey 'choke'

  • Opposition parties lead demonstration calling for sack of bank of Ghana govnors over mismanagement allegations

  • Protesters mount roadblock, destabilze activities for Abuja airport

End of Recommended articles

Di president describe di protest as threat to national security.

E add say im goment go treat evri threat to national security as "existential threat to our republic", and say all di actors wey get hand for di threats dem go see dem as "treasonous".

Still di Kenya leader say di protester raise “important question” wey dem need to address differently.

E no forget to thank di young pipo wey bin champion di protest for raising all dis important questions as im say, dem must to "conduct am for manner wey respect di rule of law and respect for institutions".

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, AFP

Police for Kenya capital, Nairobi, shoot, kill at least five pipo during one big protests against plan to increase tax, according to Kenya Medical Association.

One tori pesin from Reuters news agency also bin report say e count di deadi bodi of at least five protesters outside parliament.

Earlier, di protesters break through police barricade, enta di parliament, set part of di complex on fire.

Dem also set fire for Nairobi City Hall.

About 40 people na im dey receive treatment for hospital.

Kenya police bin kontinu to fire protesters wit live bullet and teargas as dem try stop dem make dem no enta parliament on Tuesday.

Some protester still enta di parliament building burn part of am.

But Reuters news agency bin later report say police drive di protesters comot from parliament.

Dem also smuggle some of di trapped lawmakers comot from wia dem hide underground for parliament through tunnels, Reuters say.

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, EPA

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (4)

Gunshots sound for di kontri capital Nairobi.

Earlier one NGO, di Kenya Human Rights Commission, bin report say police shoot four protesters outside parliament.

Di group say one pesin don die. Oda sources neva confam di death yet.

"Such actions dey unacceptable and make up to serious violation of human rights," dem add.

BBC reporter also say pipo also die for oda parts of di town from police shooting and some injure.

"Earlier I bin dey Nairobi expressway wia I see deadi bodi for street. Dem bin lie inside dia blood, wit one wey dem completely blow im head comot."

Video show as protesters dey push enta parliament wia MPs just vote to approve di controversial finance bill, wey go raise some tax.

Hundreds of protesters now don enter di complex wia parliament dey sit, live TV fotos show.

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (5)

Wia dis foto come from, KTN

Privately owned KTN TV station wey dey cover di protest live say di goment don threaten dem to to dey feem di protest as e dey happun.

Di 24-hour news channel say dem go stand gidigba, no shaking as dem kontinu to do dia journalist duties even wit di shutdown order.

"If di goment go ahead to close us down, we go kontinu to bring you di tori as e dey happun for our social media platforms," di station newscaster say.

According to NetBlock, internet availability don drop sharply.

E no dey usual for authorities for Kenya to block internet access and just some few days ago dem say dem no go limit internet access.

Most of di protest na for social media platforms like TikTok and X dem bin organise am.

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (6)

Wia dis foto come from, EPA

Thick clouds of tear gas don take over di parliament as police try to push dem out.

Until some minutes ago, MPs bin dey debate di controversial finance bill bifor dem pass am.

Kenyan police bin earlier fire tear gas and rubber bullets to scata protesters for di capital, Nairobi, as di anti-tax demonstrations across di kontri continue.

Businesses shut down and transportation don dey paralysed for di city, with police wey dey face di demonstrators.

Di protests wey di youths dey lead bin dey call on MPs to reject proposed tax increases.

Goment, wey don row back on some of di most controversial measures, say new taxes dey needed to fund spending programmes and lessen di debt burden.

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (7)

Crowds bin also gada for many oda parts of di kontri, with local Kenya newspaper the Daily Nation reporting protests in about 30 of di kontri 47 counties.

Lawyers and human rights groups bin don express concern about anyhow arrests and di intimidation of activists during earlier protests.

E come as reports say at least five prominent social media users don dey abducted early mor-mor, hours before di demonstrations.

Goment don defend di taxes as necessary for raising additional revenue to reduce Kenya significant debt, but last week dem accept some demands.

Dem scrap some controversial taxes including proposed taxes on bread, cooking oil and motor vehicle ownership as pipo protest.

But di protesters say e no dey enough, and dey call for di complete withdrawal of di bill.

Despite dat, majority MPs pass di controversial bill during im second reading and on Tuesday dem dey debate di various amendments, to remove some of di clauses wey di government see say get issues.

More fotos from di protest on Tuesday

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (8)

Wia dis foto come from, Reuters

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (9)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (10)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (11)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (12)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (13)

Kenya protest: William Ruto address protesters as MPs pass finance bill - BBC News Pidgin (2024)

References

Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Lidia Grady

Last Updated:

Views: 6020

Rating: 4.4 / 5 (45 voted)

Reviews: 84% of readers found this page helpful

Author information

Name: Lidia Grady

Birthday: 1992-01-22

Address: Suite 493 356 Dale Fall, New Wanda, RI 52485

Phone: +29914464387516

Job: Customer Engineer

Hobby: Cryptography, Writing, Dowsing, Stand-up comedy, Calligraphy, Web surfing, Ghost hunting

Introduction: My name is Lidia Grady, I am a thankful, fine, glamorous, lucky, lively, pleasant, shiny person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.